Di word wey leader of Izala Scholars Council, Sheikh Sani Yahaya Jingir, tok about Muslim-Muslim ticket and Christians na infidel never finish but he don tok hagain say he nor get one regret.
Na for di mass wedding wey Kano State organize for pipo nai Jingir take say he back Muslim-Muslim any day anytime and any Christian wey nor like am, make he use head jam tranforma.
But wey BBC Hausa come dey interview am nai Jingir say, he nor dey do am cus of President Bola Tinubu but to stand with who he be as a Muslim.
“I nor dey sorry. I nor go stop to support Muslim-Muslim ticket weda dem curse me or not. Na dem start am and we hear am for dem hand, so make everybodi take am as dem see am,” Jingir.
