+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Support Tinubu Cus He Know Wetin To Do – HRM Lucky Ararile

A first-class Royal Father in Delta State and retired Air Vice Marshal, His Royal Majesty and foma Air vice Marshal, Lucky Ararile, di Ovie of Umiaghwa Abraka, say President Bola Ahmed Tinubu dey try hin best time epp di kontri and Naira so that production go increase.

Di king tell tori pipo on Saturday, 28 Oct, for hin palace say e go beta make naira stand well on e own so that govimet and investors fit plan with am.

Di pilot say weda naira reach N1,300 or N1,500 to a dollar, before e stand well nor really mata, wetin mata be say he stay there so that investment for happen with assurance.

He come still say Nigeria pipo go get many advantage as dem devalue di naira, cus tins wey dem dey but outside Nigeria nor go come be like that again.

[FD]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM