+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Wan Show Love To President Tinubu – Rick Ross

Americana 48 years rapper, Rick Ross say hin wan show love and bring attention to Nigeria culture especially to President Bola Tinubu.

Di rapper drop di video for X on Wednesday say he wan show love to world leaders so that lite go shine for those places and where he wan take start na Nigeria and president Tinubu.

Rick Ross said: “I wan show love to di presidents of some of these amazing kontris. I wan make pipo see dem culture and wonderful artists. But make we start with Nigeria, Bola Tinubu

E never tay wey Rick Ross tok say hin wan do collabo with some African singers like dem Asake, Odumodublvck, Ghana’s Stonebwoy and Black Sheriff, and Nasty C from South Africa, all go dey for hin new album, ‘Champagne Moments.’

Before now di Americana rapper don sing with P-Square, Yemi Alade and Tanzania’s Diamond Platnumz.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM