+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Jaguda Boys Tiff Food From Trucks Wey Karey Food Stuff Dey Go Kaduna

Hunger don dey cause different problem for Nigeria, anoda one don hapun for Suleja side inside Niger State as jaguda boys block trailers wey karey food stuff, sotay sojas get to come dey shoot.

One Alhassan Abdullahi wey dey there wey everytin dey hapun tell tori pipo say di trailers wey load with food dey travel from Abuja dey go Kaduna before jaguda boys use burn tyre take block road.

He say na bags of rice nai dem karey pass join with other food stuff before sojas come reach di place.

According to Abdullahi na only with di sojas wey reach di place as dem start to shoot nai only make di jaguda boys fear small to run.

But even with that, many of dem still go with bags of rice, cartons of spaghetti and different kind of food stuffs.

Abdullahi still tell Daily Trust say okada men still dey say dem wan protest the food hunger, he say na since yesterday dem wan bin do am but he nor know why dem nor do am.

Remember say everybodi for di kontri don dey cry di way tins take hard for every where, as food for common man don turn gold.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM