+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Update: Police Don Free Chairman of Labour Party Wey Dem Arrest

On Wednesday for Benin, nai di State police arrest di National Chairman of Labour Party, Julius Abure.

Abure bon enta Edo State cus of di govinorship primary of LP wey dem wan do on Friday.

With di way police take arrest Abure e come make many pipo protest go di zone 5 headkwata of Benin Command.

But according to Tijani Momoh di resin wey make dem arrest Abure na base on petition wey pesin write against am, and na di Inspector General of Police nai say make dem go arrest am.

Momoh say dem give order make nor bodi see Abure cus video and recording dey wey di pesin wey karey case to police, show say dem beat am wey he come Hass last year.

He say di case wey dey Abure head na, hin try to wan kill pesin, karey gun and other bad tins. Investigation don start and any other tin dem go let world know.

Know before dis arrest yesterday, Abure and some members for LP inside Edo State don dey get some kwanta say he put some kind candidate wey nor suppose join di 2023 election but Abure say dem dey lie.

Police don free Julius Abure di National Chairman of Labour party wey dem arrest on Wednesday for Edo State.

Dem release Abure around 2:0’clock early mormor and di National Chairman don even tok with him supporters.

He say dem just wan disturb di party cus of wetin hapun for di 2023 general election but dem plan nor go work.

Abure come still say di state chairman, Kelly Ogbaloi, and di state youth leader still dey with police but before today go finish dem go come out.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM