+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Yabbing For Minister Of Women’s Affairs As She Give Women Keke And Sewing Machine

Many pipo for social media dey vex for di empowerment program scheme wey Minister of Women’s Affairs, Uju Kennedy Ohanenye do as she give out 30 keke and sewing machines to women.

Na for her X hakant she take display do keke and sewing machine say na women nai she run am for.

She tell tori pipo wey dem dey interview her say di resin wey make her do di empowerment na to make women stop to dey quarrel dem husband, now dem go fit work add to feeding monie and even pay children skool fees, from there dey save small small.

Ohanenye for her X say: “For wetin I tok say I go stop di way pipo nor dey get work and to empower women, nai be this Pink Riders Transport Scheme and upgrade of awa sewing factory.

“I don see di first batch of di keke and industrial sewing machines.

“Di pilot scheme of dis machines especially di Pink Riders go start from Abuja before we take am to other states.

” Di stage wey we dey na talk and do cus Nigeriausg work,” ma wetin Ohanenye tok.

Di mata nor just sweet for some pipo ear as many dey say why she go karey keke take go do empowerment for women.

Some others come dey say she suppose use other tins for her empowerment instead of keke and machines.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM