+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

If You Nor Want Swellup Eye, Nor Tok Wey Your Husband Dey Tok — Minister Uju

That mouth wey you dey sharp upandan anytime wey you and your husband dey argue for hass beta stop, learn to dey quiet na di advise wey Minister for Women Affairs, Uju Kennedy-Ohaneye, give women.

On Wednesday nai madam Uju take dey beg women for di conference wey Ministry of Women Affairs hold for Abuja.

According to di minister, if women dem learn how not to dey tok back of dem husband dey tok, e go save dem from beating wey for cus wound or say pesin even kpai.

She dey beg women make dem nor dey find trouble weda na for dem hass or outside cus hass wey get peace nai pesin fit achieve beta.

Wey you shut up nor be e mean say you be fool, make your husband shout tire just do like say you be mumu but you nor say you nor be fool.

Nai she drop update say if di man don tok finish, if na gud pesin e go come back to beg, but if e nor beg just leave am cus if that time your wan do gragra na your bodi go hear am.

“Di same man wey wound you go still come.tell.you sorry, wetin you go do? You go kill am? Even if we gada to fight for you and one of your eye komot, we go for give you back? Nai make dem say prevention is beta than cure.”

Di minister say she go lead protest go di office of Attorney General and Ministry of Justice make dem sign law to do mobile court to judge cases of sexual and gender abuse.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM