+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Two Pipo For Gombe Sell Bags Of Rice Mix With Chaff

Hunger dey nor mean say pesin go drink water from gutter.

Police don catch two pipo wey mix rice dirty join inside 57 bags of rice to sell for market pipo.

Dis pipo na Bashir Haruna, 35yrs from Dubai quarters for Gombe plus Mohammed Isah wey be 54 yrs for Jibulu quarters inside Kumo, dem don confess give Gombe police say dem don mix different bags of rice with di dirty wey dem komot from rice dey sell give pipo.

Tokpesin of di command, ASP Sharif Sa’ad, confirm say dis two pipo really mix chaff wan sell for market as rice.

Di Commissioner of Police, CP Hayatu Usman, don already send dem to court and say make pipo dey careful for di kind sack of rice wey dem dey buy so that dem nor go fall maga for dis kind scam.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM