+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tinubu Result: Join Me Fight To Open Di Truth, Atiku Tells Obi And Kwankwaso

Atiku Abubakar of PDP dey beg Peter Obi of Labour Party and Rabiu Kwankwaso, of New Nigeria Peoples Party make dem come join bodi with am to drag di truth come out about president Bola Tinubu certificate result.

Na for di press conference wey PDP and Atiku do yesterday, Thursday for Abuja nai di Atiku take dey make di call.

Atiku say di only tin wey go make am nor drag Tinubu again, na afta Supreme Court don dem final judgement. If na him loose say he go waka lost.

Know say Atiku bin go meet one court for Illinois for USA make dem tell Chicago State University to bring all di results wey Tinubu take go di skool.

Atiku say na cus big difference plenty inside di certificate wey Tinubu give INEC and dis new one wey hin get from CSU hin wan add an join he appeal for Supreme Court.

He say na big disgrace for di kontri to dey tok about wayo for result for where president dey and cus if that hin wan make dem end di mata once and for all, cus hin love di kontri too much.

“So nai make I dey call Nigeria pipo wey dey tik of di kontri to beta, Peter Obi, Rabiu Kwankwaso and leaders for different political parties, make una join hand with me make we save awa kontri from laugh outside.”

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM