+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Jacob Zuma Wan Be President Again For South Africa

South Africa Electoral Court don give go ahead to foma President Jacob Zuma on Tuesday to contest as President for di next election.

Wey Zuma finish as President, nai di court call am to ansa mata wey dey he head for corruption but di man nor gree show face, naso dem send am to prison for over two years.

Normally for South African pesin wey don go prison stay pass one year nor fit come contest for election unless say he pay for some tins to clear am

But na wey di court don clear Zuma on Tuesday he don dey try stand leg strong for uMkhonto weSizwe Party, di party wey hin stand with now.

Know say na African National Congress party nai Zuma dey bifor and naiem  dey lead dem until he come change party to di new one.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM