+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Teree Women Dey Effrun Police Hand Cus Of High Drug

Police don catch teree women wey dey sell laughing gas, Canadian Loud, and codeine for Warri afta dem get info to raid where dem dey hide.

As operatives for Effurun area command reach di place foe Ogbomoro and Ugolo kominiti around 9:20 on May 7, no be small drugs nai dem see.

Wey SP Bright Edafe dey tok on di mata he say na one 25 years Favour Isaac nai be di drug baron and di two odds wey dey follow her na Favour Felix wey be 24 years and Samson Precious, 19 years.

Police say di major supplier of di network, na Rukevwe Tega Isaac and he don gbaise but dem dey find am with touch and candle so dat hand fit touch down on di oda place wey he don spread to.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM