+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Keke Rider Dey Luk For im Johnthomus Afta Shoemaker Touch Am For Ghana

With all di wahala of pio johnthomus wey dey lost any how for Kasoa di Central region for Ghana, many pesin don dey wonder how dem fit take stop am.

Just last week one 47 years man wey dey ride keke wey Ghana pipo dey call Pragya, pipo say hin gbola lost as he shake one shoemaker.

On Monday again, di pipo for Kasoa nearly kill one shoemaker afta one 27 years guy wey dey ride pragya say hin gbola lost.

Afta Yusif Bukari shake di shoemaker man nai he notice say hin johnthomus nor dey where e suppose dey again.

Naso e start to shout, pipo catch di shoemaker give am enough beating wan even kill am wey police come save am.

Di Kasoa Central District Police Command say di shoemaker dey with dem and dem dey do investigation ontop di mata.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM