+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Kontri Too Hard I Nor Do Biyday Party Again – Jide Kosoko

Nigeria film actor wey pipo dey always see for TV with different character, Jide kosoko don shift hin biyday celebration of 70 years cus of how tins hard for di kontri.

On Sunday for inside Instagram nai di actor take let pipo know say di party wey hin suppose do to take celebrate he 70 years biyday, nor go fit hapun again cus of di too much hunger wey dey di land.

Hin say he understand wetin dey hapun for di kontri cus he dey inside di kontri but tins go soon change for beta.

Di actor come still greet all he co-actors join with fans wey contribute moni say dem wan use am celebrate hin biyday wey hin still dey alive.

Na on January 12 nai Kosoko turn 70 years,  but base on how kontri hard, di man don cancel party.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM