+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Mr Ibu Don Die

Tori wey just dey drop for awa ear be say, John Okafor wey evwry bodi dey call Mr Ibu, don die for di hospital wey dem take dey reat am since he cry come out about he sickness.

Mr Ibu na jus  62 years wey hin take die so afta one disease wey dey make blood gada for he leg finally delete am today, Saturday, March 2.

Remember say d family bin give update about di actor health of how dokitors take cut him leg so that he fit stay alive.

Dem later come tok say dokitors get cut di second leg. Afta di many operations di actor nor come dey happy like dat again, join plus say di family come dey drag demsef for social media about who chop and who nor chop moni.

According to di family, Mr Ibu don dey breathe with di epp of life support since and e BP just dey over high pass normal until he finally bow to death dis evening, leave hin wife and children for dis world.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM