+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Liberia Start National Prayer Day

Di kontri of Liberia don say every second Friday for April every year dem go use am take dey fast and pray for di kontri make e for beta.

Na di President of di kontri, Joseph Nyuma Boakai, nai tok so through di mouth of di Foreign Ministry on Friday, April 12, 2024.

Di call na to all pastors, elders, deacons, Imams, priests, evangelist, and all members, nor mata di religion wey di pesin dey but di main tin na to call on God for di good if di kontri.

Every year wey April reach di president say make everybodi gada for where dem take dey worship and nor be to wear big clothes but come seek God face from 8:00 for morning.

Dem nor just do am as dis new law folow diaw of di land for Liberia and during that time all di public offices, business place, market go close so that pipo fit go pray.

Dem still say all di pipo for di kontri plus di outsider wey dey inside di kontri, go stop all dem work for that day to show dem love for God.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM