+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Deltans Unite

Chairmo for Delta State Inter Party Advisory Council of Nigeria (IPAC), Mr. Fred Obi don tell Deltans say make dem begin to dey see themselves as one and say make dem begin to think of those things wen go make peace and unity dey among themselves say becos if dem work against each other, e go divide them.

Obi when give the advise wen he dey voice wit news people for Asaba, come tell Deltans say make dem change their ways and say make dem desire to make progress for d year 2019.

Even as the state dey prepare to elect new leaders between February and March wen go handle the affairs of the state, Obi come warn Deltans say make dem dey always dey put the interest of the state first before wetin dem go gain.

He come say make all Political Parties and their Candidates dey criticize well about the policies of those wen dey for Government and say make dem suggest solutions without partia instead of dem to dey spoil their image becos e no make sense at all….

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM