+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make We Epp Zack Orji, Minister Of Arts Beg

Di Minister of Arts, Culture and Creative Economy, Barrister Hannatu Musawa dey beg Nigeria pipo make dem shake bodi and do sumtin for to epp di life of Zack Orji wey dey act film.

Musawa dey beg make pipo epp di Nigeria film actor afta hin fall for baffroom and nor come fit dey waka or tok before dem come do brain surgery for am on January 1, 2024.

Na on Tuesday wey do minister go see di actor for di private hospital wey him dey for Wuse inside Abuja nai she take dey call pipo to come show love to di actor.

She say Zack na material for di kontri as she dey tell di family to take heart.

Naso di wife of di actor Ngozi Zack Orji, come dey greet di minister as she karey time take come visit her husband.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM