+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Kill Two Kidnaper For Ekpan

Two kidnaper nai Delta State Police Command don kill for Ekpan side as dem dey state as dem dey use pesin wey dem tiff run.

Na di Police Public Relations Officer for di state, DSP Bright Edafe, nai tok am.

He say na di Ekpan DPO, CSP Aliyu Shaba nai get di infor wey dem fit take catch di kidnapers and save di pesin wey dem tiff.

“For December 30, 2023, nai one 23.year boy park hin Black GLK 350 Benz SUV along Jakpa Road come leave he broda inside go do sumtin.

“Naso pipo come tell am say teree men don go attack di motor karey am with e broad dey go where dem nor know.

“As di Commissioner of Police hear di mata nai he tell di DPO of Ekpan,  CSP Aliyu Shaba make dem go safe di pesin wey dem tiff.

“Nai DPO karey hin team from Ekpan enta road.

“Nai dem reach bush for Ekakpamre, naso kidnaper and police start to dey shoot each other.

“Na there nai two of di kidnaper take wound then one come run with serious gun wound.

“Wetin di team see from di kidnapers hand na na di.motor.wey dem tiff, teree gun, plus two single barrel and one double barrel gun with two cartridge.”

Edafe come still say dem rush di two kidnaper wey get wound to hospital but dokitor confirm say dem don already die. Then dem dey try all dem best to make sure say hand touch di one wey run with wound.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM