+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Man Wey Dey Spin Girl For AFCON, Beg Wife For Forgiveness

As pipo dey go AFCON 2023 for Cote d’Ivoire to watch match some dey go find partner.

That one nai be di case of Anselme Santos as hin dey do lovi tok with one lady as match dey go on.

For inside di video wey don spread like wide fire everywhere, na for Charles Konan Banny Stadium nai di man take dey spin di lady wey Senegal and Ivory Coast dey play on Monday.

Pipo don dey even use dey use Santos pinsure take dey do laugh for social media as di ivorian man dey tok inside di lady ear afta Ivory Coast don take Senegal down.

According to Actu Foot, Santos don drop full detail of wetin hin dey ask di lady for ear.

He say di tin he try porchu for di lady e nor fit even get am and now he dey sorry as every tin don cast.

Wetin Actu Foot say Santos tok with e mouth “As di game dey shak, nai I tell di woman for di video say make she give me her nuba. I nor mean  am like that but she still nor give me di nuna. Nai I just leave her. I wan use dis chance take beg my wife and children make dem nor vex.”

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM