+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Warri Refinery Go Start Before June Finish – NNPCL

Gud news go soon start to role for Warri as NNPCL say dem go finish all work for Warri Refinery and Petrochemical Company before di first kwata of dis year finish.

Before NNPCL dey tok dis new update, Minister of State for Petroleum Resources, Heineken Lokpobiri, don bin yarn on Wednesday for Port Harcourt say dem still dey work for Warri refinery.

Di Warri refinery get  power to produce 125,000 thousand barrel of crude oil everyday.

No be only crude sef di refinery dey do as e get petrochemical part wey dey produce polypropylene and carbon black.

According to di Chief Corporate Communications Officer for NNPCL, Olufemi Soneye say dem don plan to finish di mechanical stage of di refinery for di first kwata of 2024.

Remember say na last year nai dem finish di refinery wey dey for Port Harcourt and govimet say afta Christmas break dem go start to produce 60,000 barrels of crude oil everyday but that one never still hapun till today.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM