+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Man Wey Tiff Salt, Onions Don Land For Prison

On Wednesday for Ado-Ekiti nai court send one 20 years guys make dem leave am for prison cus of one woman pot of soup wey hin go tiff for di state.

Di name of di guy na Monday Ojo and dem say he nor get one place wey hin dey stay, na to dey waka about from one place to anoda.

Di police pesin wey karey Ojo case go court na Moyosola Adesola nai say di owner of di hass Mrs Ajala nai come complain give dem.

She say for di hass wey Ajala dey stay for Falegan, Ilawe Road inside Ado-Ekiti, nai Ojo enta go tiff pot of soup, indomie, salt, onion and akpu.

Di owner of di hass say wetin di tins wey di guy tiff all of dem na N300k.

Wey di Chief Magistrate Mrs. Taiwo Ajibade come dey read di charges for Ojo head, he say he nor dey guilty.

Court come say make he use N50k and one pesin wey get N50k to stand for am.

Dem karey di case go April 23, to know di outcome of di bail.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM