+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

My Bodi Don Come Down Afta Supreme Court Judgement, Buhari

Di foma President of Nigeria, Muhammadu Buhari had hailed the Supreme Court for its judgment after months of legal battle in determining the true winner of the February 25 presidential election.

For wetin di foma president write through hin tokpesin, Malam Garba Shehu, he say make di opposition parties just join hand work with Tinubu and Shettima.

Buhari advise say make dem allow di new govimet work so that pipo go benefit from wetin APC promise.

He say as supreme court don tell Atiku Abubakar and Peter Obi say na Tinubu nai really win, hin temperature don come down and many pipo for di kontri too dey happy.

“Now wey we don reach di last bus stop, afta 8 months of spending big monie for court, di kontri now go rest. Di opposition don fight and e good. But as dem don loss, make dem work with Tinubu govimet.

“Make dem allow di govimet to run dem administration so that pipo go see wetin APC promise dem.”

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM