+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Na State Govimet Fit Develop State-Daniel Reyienejwu

Di foma member wey dey rep Warri Federal Constituency for National Assembly, Rt. Hon. Daniel Reyienejwu say make pipo dey put dem mind for dem state govimet instead of Federal Govimet.

He say every month nai FG dey pay big monie give state to take run tins, so make pipo gold state govimet dem.

Na awa tokpesin nai Reyienejwu tok to as hin dey tok about di suffa wey pipo dey pass through and how President Bola Tinubu dey try to make tins beta.

He say state govimet dey kolet monie for di state to use for di pipo and e go beta make pipo dey see wetin dem dey use di monie do.

Di foma lawmaker say Tinubu don release billions of monie give state government wey dem never see before cus of fuel subsidy wey dem komot, so that suffa go reduce but pipo still dey shout FG.

[FD]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM