+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Niger, Mali, Burkina Faso Form Joint Force Wey Go Fight Terrorist

Di teree kontris for West African wey military don take over power and dey run tins say dem go join power togeda make dem fight terrorist komot from dem region.

The three Sahel countries, Burkina Faso, Mali and Niger don dey face many problem of terrorist for di North part of dem kontris, wey come make dem put head togeda to see say all di attacks stop.

Cus of di Jihadist attack join with other problems dem join force with Russia porchu dem colonial masters France komot from dem place.

Na di Oga of Niger, Chief Moussa Salaou Barmou nai announce for Naimey, wey be di capital of Niger say dem go soon start di joint force.

Know say na afta ECOWAS give di teree kontris sanctions say why dem go take power from civilian turn am to military rule, nai dem dey vex pull cap give ECOWAS say dem nor dey do with dem again.

ECOWAS sha come komot some of di sanction wey dem take slam di kontris, then tell dem to remain for di bloc so that epp fit dey touch dem.

Before now Burkina Faso, Niger and Mali don already create Alliance of Sahel States, komot from international force and G5 wey be say na to fight terrorist for di region.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM