+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nigeria Bank Give Me My Real €5000, Man Drag Sterling Bank

One man wey dem call LegendaryPapi for social media don drag Sterling Bank of Nigeria say dem give am fake 5000 Euros instead of real cash wey hin put for dem bank.

Di man start di dragging for him X account narrated, tok how he take put di monie and wetin happen.

He write for he handle wey be @Dblinkz say: “On 24 of January 2023 I go put 5000 euros for my domiciliary account for @Sterling_Bankng at… No 9 Ali Alikilu Road Kaduna branch Nigeria.

“I come go di bank for 30th of May, 2023 to go withdrawal di 5000 euros, I reach di back wey I take deposit di monie dem say dem nor get reach di 5000 make I kolet 3000 from dem and go their main branch to kolet di rest. But I nor gree cus dem go charge me different.

“Nai I go di main branch to kolet di 5000 euros.. dem give me for 500 euros each, do resin wey make I go kolet di monie na to give my friend make hin epp change am and pay my pay part of my skool fees as he dey track back to UK, but as he go @eurochangeFX nai dem seize di monie say na counterfeit.

Di man say hin don try tire to make sure say di bank ansa am well since dem know say di monie na fake but di bank just dey drag leg.

“I don dey wait since for @Sterling_Bankng to solve di issue and return my monie wey I suffa work for but dem just dey do swegbe folow di mata.”

He come say even di serial nuba wey dey di counterfeit na di same with wetin di bank dem get for dem bank. Come put di letter wey Euro Exchange FX give am say di monie na really fake.

“@eurochangeFX don send confirmation letter with dem letterhead to show say na really fake!!!

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM