+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nigerian Artists Lost For Grammy, Davido Salute Tyla Wey Win

Tins nor go well for David Adeleke aka Davido for di Grammy nomination category wey he song dey for di first time, as he lost di category give South African rapper Tyla.

Di song wey di 66th Grammy put for di nomination for Davido na Best Global Album of di year, for ‘Timeless’, Best African Performance for ‘Unavailable’ and ‘Best Global Music Performance for ‘Feel’.

But mata nor come play like that for David as na Tyla song ‘Water’ nai come win di Best African Music, then for di Best Global Music Performance na ‘Pashto’ wey Béla Fleck, Edgar Meyer & Zakir Hussain sing with Rakesh Chaurasia nai win am, before di ‘Best Global Album’ come go to Shakti song ‘The Moment’.

Even Burna Boy wey dem nominate for four categories lost to Tyla song ‘Water’ for di category of Best Melody Rapper, join with Asake and Olamide.

But Davido nor resin am again as he don go X on Monday dey salute pesin wey win am for di nomination.

He write say congratulations @Tyllaaaaaaa! as you win. This na big one for Africa! Kwatinue to set shine!”.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM