+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Notin bad say President Tinubu Karey Hin Children Travel Go Qatar

Di visit wey Presido Bola Tinubu wan go do for Doha, Qatar, for investment and business to come Nigeria two of hin sons Seyi and Yinka name don join di delegates wey go folow for di trip.

Different mouth don dey drop side tok why dem go folow for di travel since na children dem be and nor get any position for govimet office but Otega Ogra, Senior Special Assistant to President Tinubu on Digital/New Media, say notin bad inside.

Na for X platform nai Ogra take dey drop e support say no be strange tin for world leaders to karey dem children join bodi travel go foreign place.

According to di Special assistant, na even normal tin cus Canadian PM Trudeau dey always travel  abroad with him family, even UK PMs though say dem nor dey loud am.

If you lukam from public eye, pesin wey travel with e family nai fit get beta luk form pipo cus dem go see say e family dey okay, while some dey use am teach their children.

Even pipo like dem Obama, Clinton, Bush, Trump and di rest dey karey dem family for foreign. So make pipo know wetin dem dey spit komot from mouth.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM