+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NSCDC Close Fake Refinery For Gombe

Nigerian Security and Civil Defence Corps Command for Gombe State don close don one fake refinery for Gombe on Thursday.

Wetin Commandant Muhammad Muazu, tok  sag dem arrest di man wey dey produce gasoline for inside Federal low-cost area for di state.

As dem karey di suspect dey parade am, Nai Muazu say na with di epp of pipo wey dey stay around wey come complain about di smoke for di area nai dem take go report.

He say, “The fake refinery dey for Gombe town. Dem dey use wayo take dey produce gas, we don get di info for weeks and na yesterday nai God epp awa men to catch those wey dey behind.

“Na di community pipo nai go report say dem dey smell one kind odour for di area and na so we come dey monitor untill now. Any name wey dem call di place e nor mata, di tin be say e dey bad for health.”

Wey di Managing Director for di refinery, Abubakar Aliyu, come dey tok, hin say no be refinery nai he do but na pyrolysis.

He say hin nor know say e nid SON registration cus na tyres, nylon, co and other tins hin dey use as raw materials.

Di man wey be 44 years sayna afta he go one workshop training for Abuja nai he take come back to open di pyrolysis, “Wey I know of how bad e be to human being life nai I go buy land far from where pipo dey stay. I nor know say I go nid SON registration but I bin don dey get clearance from Ministry of Environment.”

Wey he still dey tok, Aliyu say, “Since I dey small, I know how to make motor. I nor dey do am mysef I dey call builders wey dey give me wetin I want. Na childhood, Agricultural Engineering nai I read for skool and before then I don sell recharge card and phone. Na teree weeks ago nai I start dis business.”

Some pipo wey dey stay around say di odour from di refinery wan finish dem and di owner nor dey hear word afta dem don shout tire.

[Punch/SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM