Delta State Public Relations Officer, SP Bright Edafe, don tok habat Assistant Superintendent of Police, Nuhu Usman, wey go kpuf Mene Ogidi for Effurun say hand must touch am.
Wey he dey tok for Channels TV, nai Edafe say dem send ASP and odas to go bring di suspect afta di park check di parcel come see gun and bullet inside but Usman go do anoda tin there.
He say dem don bin tell moto park say any parcel wey pesin wan send make dem check am cus bad guys don dey use am karey drugs and gun. So on Sunday wey Mene come nai di park come check di waybill bifor e komot, only to see gun inside.
Di tokpesin say dem don use nite moto send ASP Usman from Asaba to Benin then to Abuja cus he nor fit tok weda na devil nai push am but di truth be say dem go charge am for murda.
