+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ondo PDP Dey Protest Make Gov Akeredolu Komot From Seat

Di seketaria of Peoples Democratic Party (PDP) for Ondo State di one wey dey for Akure, dem don close an down today .

Tori say all di drama nor dey far from say some of PDP members don say dem go protest as Govinor Rotimi Akeredolu nor dey sitdon for office since di time hin come back from obodo  oyibo.

Even as e dey now police and DSS don full ground for di seketaria.

Na for September this year nai Akeredolu take come back from di three months travel wey hin go do for Germany to treat sickness wey nor bodi know di name.

Afta di govinor land Nigeria, nai he karey hinsef go hin own house for Ibadan and na from there hin take dey run di state. Na all dis one nai make pipo come dey say make hin resign.

On Sunday, PDP wey be di opposition party say dem nor go gree again as dem go do protest for Akure make dem tok where Akeredolu dey.

By now, di PPRO of Ondo State, Funmilayo Odunlami-Omisanya never put mouth for di mata.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM