+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Osun Govt Beg Hin State Women To Take Cervical Cancer Vaccine

Govimet of Osun State dey beg pipo wey dey stay for di state make dem grab di mass vaccination campaign wey dem wan do against cervical cancer to epp women life for di state.

Na on Wednesday for inside Osogbo wey dem dey do di program nai di Special Adviser to Osun State Govinor wey dey handle Public Health, Dr Akindele Adekunle dey on ground to tell pipo di important tin wey dey to get vaccine against cervical cancer.

Even other stakeholders still dey present to know more about di vaccine wey dem go start to give from October 24, 2023.

Di stakeholders wey come afta di program dem own na to karey di news go tell pipo for grassroot about di disease and how women fit do make dem no get do sickness.

As dokitor Adekunle dey tok on how dem for taks fight cervical cancer, hin say na cus di state govimet put di pipo first nai make Ademola Adeleke administration dey make sure say dem start dis vaccine to save women.

“We nor fit do am by awasef. We nid una support. Wey pesin take do HPV vaccine, e go epp fight against cervical cancer,” na wetin dokitor Adekunle tok.

Wetin di Southwest Regional Coordinator of World Health Organisation, WHO, Dr Isiaka Ayodeji, tok be say na Osun state nai be one of di 16 states for di whole kontri wey go join start di campaign vaccine against cervical cancer wey dem wan start for October 24.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM