+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Our Slippers Don Already Cut, We Nor Fit Trek To ECOWAS Again– Niger Leader

Lailai to lailai, you see that Mohammed Bazoum, foma President of Niger wey we komot last year from seat, e nor go ever smell outside again.

Dis na di new update wey General Abdourahamane Tchiani, di military leader of Niger Republic tok.

No be only that one sef, hin say make ECOWAS forget that beg wey dem wan use kona eye take give dem, cus di teree kontri wey don dust dem slipper say dem nor do again for ECOWAS, dey only luk front and nor get time for di bloc again.

Remember say na just January dis year nai Mali, Burkina Faso, and Niger draw bodi komot from  member of Economic Community of West African States.

Gen. Tchiani say even with di beg wey ECOWAS dey give dem nor go resin am, cus na becus dem be member for di bloc nai make dem stop food,mericine, lite and even freeze dem hakant.

He say di tin pain dem wella, nai make dem tok to their friends, all of dem come gree say dem go later ECOWAS wey dey under foreign bodies.

Di Junta leader say hin nor dey fear about result of say dem komot, cus God wey dey feed bird go make way for dem.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM