+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Over 50 Okada Men Kill Police Inspector For Asaba

One inspector Festus Onori of di Nigeria police wey dey under Marine Police Station for Cable Point for Asaba nai some okada pipo don kpuff for Ogwashi-Uku, inside Delta State.

Inspector Festus na just 45 years before di okada pipo wey dem say all of dem come from north side, gather kill di man in front of he wife and three children.

Wetin Mr Austin Onori, di senior broda of Inspector Festus tok be say, di late inspector and hin family dey go church wey one okada man from Hausa side just run jam hin motor for Okpanam close to Asaba.

Naso di Inspector come wan park well to know wetin really happen but with surprise naso more than 20 okada riders don show with sticks and other bad tins for hand to attack am.

As inspector Festus see wetin dey sup, nai he jump enta motor dey run.

“As hin dey drive dey go with fear for he life, naso di okada riders dey pursue am. Na wey hin reach Marble Hill Okpanam, nai he bend enta di road say di riders dem nor go folow again, but for where dem still folow.

“Dem pursue am reach Ogwashi-Uku Community near Kwale, na for Ogwashi Uku Community di express to Kwale nai he fuel take finish.

“By that time di okada men  don pass 50. Na for there nai dem catch am start to beat am for di presence of hin wife and three children untill he come die.

“Dem still scatter di motor. Na pipo wey dey pass nai come rush am go Ogwashi-Uku police station before dem confim say he don really die. We don already put di deadi bodi for mortuary,” na wetin di elder broda tok.

Di tokpesin of Delta State Command,  Bright Edafe, say hin never get official report about wetin happen to inspector Festus.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM