+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pantami need to resign-Wike

…say make local government chairmo do well

 

Governor of Rivers State, Nyesom Wike don talk say the Minister of Communications and Digital Economy, Dr Isa Pantami need to resign from office, whether or not say he make one recent statement wen he for take dey support terrorist groups.

Wike yarn dis one during one interview wen he get for Port Harcourt, the Rivers State capital on Tuesday.

According to am, the minister suppose resign immediately the information about him support for these bad guys become public matter.”

He come talk say everybody know say the federal government wen the All Progressives Congress (APC) dey lead dey sabi protect people wen get bad characters.

Meanwhile Governor Wike don tell all those local government chairmo dem and councillors wen no dey work for River state to sit up.

Wen Wike dey voice during one meeting wen he get with the local government chairmen for the state house on Tuesday, he come still blast council bosses and councillors when dey abandon their areas dey operate from other areas.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM