+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Papa Knack Hin 9 Years Pikin Tik Say Na Wife

Police for Adamawa don arrest one man wey be 42 years cus of say hin go knack him 9 years girl pikin for nite tik say na e wife.

As Shuaibu wife, Asmau Isa see wetin di husband don do to dem pikin nai she go police station go report di case.

Police arrest papa raper, hin confess say na mistake nai e take hapun cus he dey drunk and take hard drugs join.

As dem man dey say hin regret wetin hin do, he say na afta meeting he come back from meeting nai he komot with he friend go buy welding material na there dem take shayo, cum use hard drugs top am.

Tokpesin of Adamawa Police, SP Suleiman Ngurore, wey dey confirm di case, say Shuaibu say around 6 for evening nai e struggle reach hass, jump enta bed sleep, as he wake up for nite he see pesin wey sleep near am and tik say na hin wife.

Naso di papa take jump ontop hin 9 years old small dauta chop di pikin finish clean mouth.

Dankombo Morris, di State Commissioner of Police say make dem do koret investigation and punish di yeye papa Shaibu

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM