+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Army Burn Okuama Village Afta Jaguda Kill 16 Sojas

Di village for Ughelli South wey one commanding officer, two majors, one captain, and twelve soldiers die on Saturday, on Sunday fire don descend burn am.

Na 16 of di sojas nai die for Okuama as dem go dey do settle peace between Okuama and Okoloba communities before some youths wey bodi dey peper kill dem.

Wey di jaguda boys kill di sojas on Saturday nai di tokpesin of Army, Tukur Gusau, say make dem sharply find those wey karey out di act, arrest ans punish dem.

Now fire don burn hass for Okuama village, nor bodi know if pipo die join, weda na army do am, but pipo say dem see navy gunboats for near di hass wey fire burn down.

Di fear don make pipo for Okuama run for dem life  to other village for Ughelli make army nor come do deme shege banza cus sojas don dey patrol for di community.

But di General Officer wey dey in charge of 6 division Nigerian Army, Major General Jamal Abdussalam, say dem don catch some pesin wey dem hand dey for di sojas death.

Ontop di mata, Ovie of Ewu-Urhobo Kingdom, HRM Clement O. Ikolo, say dem don settle di problem wey di two communities get and wey he dey for abroad nai di problem take start sotay he get call Govinor Sherrif Oborewori to epp put mouth for di case wey dey disturb he kingdom.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM