+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Two Pipo Wey Dey Produce Fake Drinks For Lagos

Di police wey dey for Lagos state don catch two men wey dey do different kind of fake drinks dey sell for Lagos State.

Di men dem be Imo Lawrence wey be 35 and Magnus Nwonka, 42 years.

Na di tokpesin of police for Lagos State,Benjamin Hundeyin, nai open up di mata  for X, say di men even karey dem go where dem take dey produce di drinks.

He say, “Officers for Ojo Division today arrest Imo Lawrence man of 35 and Magnus Nwonka man of 42 as dem catch dem dey make fake drinks.

“Wey investigation dey go on, di suspect lead police go di yeye room wey dem take dey make di drinks.”

Even sef video dey wey Hundeyin share wey show crates of drinks, plastic, containers and bag of pure water wey dey float inside one dirty room with plenty water wey dey for ground.

E never tay o, just last week here nai NAFDAC catch some pipo wey dey produce and sell fake drinks and even tea for Aba for Abia State.

Dis kind tin come dey even make pipo wonder which kind tin dem dey really drink for di kontri.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM