+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Catch Boyfriend Wey Turn Woman To Write Exam For Girlfriend

One man wey be 26 years don land for police hand afta he turn like woman go write exam for e indian girlfriend, Paramjeet Kaur wey be 34 years.

Indian Express tori say na wey dem dey do work exam wey  Baba Farid University of Health Sciences for Punjab Faridkot district do nai officials take catch Angrej Singh as dem notice say e finger print dey different from di original candidate.

Na for DAV Public School for Kotkapura on di 7 of January nai e take happen for one of di centers wey dem take do entrance exam for di post if female multipurpose health worker.

Wetin di Station officer for Kotkapura, Manoj Kumar, tok be say Singh wear salwae kameez with stole and cap come di exam hall.

He scrape di hair wey dey e face, put makeup and gum e pinsure for di place wey e girlfriend own dey.

Di authority say dem go di girlfriend name, Kaur join for di wayo cus if she nor give permission di guy foe nor come write di exam.

Dem don free Angrez Singh but investigation still dey to check di fake ID so that di university go give more information.

Faridkot Senior Superintendent of Police, Harjeet Singh, tell Indian Express say Singh manage to enta di exam hall but officials come dey get double mind cus di pinsure wey dey for Paramjeet Kaur application form nor be di same face of di first pesin.

Afta dem do finger print e nor match with dem record. Nai dem get to know say one Angrez Singh dey play wayo to be Kaur.

E even use fake Aadhaar card, voter card and one I card.

Dem say Kaur don bin fail di exam before but Singh say she na relative of Kaur but wetin police investigation show say na lie dem nor relate at all.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM