+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don See Deadi Bodi of Officers Wey Herdsmen Kill For Ohoror

Some of di police wey dem Oga send to go save teree pipo wey dem come complain say dem dey lost, nai dem don see di police officers deadi bodi for Ohoror community.

Na on Sunday and Monday wey security agents join with vigilante for Ughelli North as dem dey waka di forest nai dem take see di dead bodis.

Di problem start for January 24, 2024, wey teree police wey dey for checking point for Ohoror get call from one Moses Progress say as hin go dey do sacrifice for river under di bride wey dey close to di police nai pipo wey dey karey Nama waka rob am.

Naso di teree inspectors jump folow go find di melu pipo but till naw dem nor see dem and even Moses dem dey find am.

Na anoda police man wey fit run komot from hand of herdsmen nai come tok wetin hin see say 6 police don die join with di 15 wey lost.

Na with di information wey di officer wey escape give nai vigilante and security take enta forest see di deadi bodi of di officers on Monday and Sunday.

Di security come destroy di hass wey di herdsmen take dey hide dey do evil and dem karey 6 deadi bodi out of Agadama bush.

Dem still dey find others but di senior security source for Delta State Police Command, say dem don put di officers deadi bodi for Mariere Central Hospital morgue wey dey for Ughelli.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM