+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Hand Don Touch Kidnaper Wey Dey Disturb Ughelli

One kidnap wey don dey disturb Ughelli and places around for long time now, police for Delta State hand don finally touch am.

Dem catch di kidnap wey hin dey chillax for one hotel wey dey for Udu according to di Commissioner of Police, CP Abaniwonda Olufemi.

Olufemi dey tok with tori pipo for Asaba base on di fight wey di Force dey against bad tins nai he take tell dem say na for March 8 2024 nai di Ughelli police take catch di tiff afta beta information wey dem get.

Di DPO for Ughelli join with other some special team nai storm di hotel to catch di kindaper.

Wey dem don arrest am nai he give information to where he dey hide his arms, na for there dem see one  pump action gun, wey get four full cartridge, one Beretta pistol and teree rounds of 9mm ammunition.

Police still dey ontop di mata and afta every dem go karey di suspect go court.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM