+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Rep Wan See Naira Marley And Mohbad Manager Cus Of Hin Music Right

House of Representatives don call Azeez Fashola aka Naira Marley make hin come to tell dem about wetin go happen to all di songs wey Ilerioluwa Aloba, aka Mohbad, sing before hin die.

Remember say na for September 12 nai Mohbad wey bin dey with Naira Marley records take die then the next day nai dem rush bury am.

Cus of so many tok about hin kpuffness nai Lagos state govimet cone set up committee to check wetin and how di singer take really die.

Naiem come make di House Committee on Justice, Youth and Legislative Compliance on Thursday say dem wan see Mohbad, Jiggy Adeoye and Naira Marley.

Na di rep member wey dey rep Ikorodu Federal Constituency,  Babajimi Benson nai move di motion before all di house come gree.

Benson say e go beta make dem look again di law wey dey protect pesin right to hin get everytin about hin music wey di singer don die, so that e go be epp to di entertainment industry.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM