+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Robbas Wey Kpai Police For Anambra Don Die

Di pipo wey go rob and kill two police officers for Uga Roundabout wey dey for Augusta LGA for Anambra State, police don catch three of dem.

On Monday here nai di CP of di State, Aderemi Adeoye say dem catch and kill three of di gang members.

Adeoye say na wey dem go raid di robbas camp for Ogboji inside Orumba South LGA on for watching nite afta dem do get information about dem nai dem take catch di robbas.

He say afta di attack wey di robbas do on Thursday, dem come still go attack di same area on Saturday come tiff one 51 years woman before security officer catch dem as dem dey run.

Adeoye say dem come see one Lexus Jeep and other tin, plus some IED, two pump action and 16 live cartridge.

“Our of di teree deadi bodi of di gand wey we kill, we don see di last.

“Na on Sunday nite nai wey take hear. We look were do ganag dey come from, nai we start to check dem until dem reach dem camp for Ogboji inside Orumba South.

“Di police officers wey die, dem be from Enugu State wey come for special mission. We go kwatinue to check for di criminal and and clean di state from all criminal act.

“We dey tell everybodi to do wetin dem dey do. We go relate any update about di mata,” na wetin Adeoye tok.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM