+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Shine Ya Eye, Fake Injection Dey Around —NAFDAC

National Agency for Food and Drug Administration Control (NAFDAC), say make Nigeria pipo especially pipo wey dey work for hospital shine dem eye open for one batch of fake Meronem 1g Injection wey dem don dey sell now for Nigeria.

Na on Tuesday nai di Director-General of NAFDAC,  Prof. Mojisola Adeyeye, take send di public message give tori pipo.

Di DG say di way dem take make di injection e nor meet up with Pfizer specification.

“Di label look like artwork version.

“Meronem (Meropenem trihydrate injection) na  antibiotic wey dem dey use take treat skin disease and disease wet dey for belle wey be say na bacteria and meningitis(Infection wey dey for brain and spinal cord) nai cause di infection for big and small babies from 3 months.

“If pesin take di fake product e go make tins bad, cus di quality and safety of di drug nor sure for one bit,” Nai Adeyeye write for di statement.

She come say anybodi week ow say di fake product dey dem hand make dem sharply stop to use mas rush go any of dem NAFDAC office wey near go drop di injection.

Adeyeye say any pesin wey don by mistake go use di product or dey see one kind tin or anoda for bodi cus of di product wey dem use, make dem go meet beta health professional wey go give dem beta advise.

[NAN/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM