+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Nor Use N927m Take Cook Food For Govinor—Abia Govimet

Di govimet of Abia State don come out to tok about di tori wey dey fly about say Govinor Alex Otti don use over N900 million take eat food and do welfare from July to September 2023, dem say di Tok nor be true.

Report come out say Otti administration don use mouth swallow N927 million for only three months for just food and refreshment, give classy pipo, allowance and package for welfare.

Di tok don too much nai di State Commissioner for Budget and Planning, Mr Kingsley Anosike come do press conference to open up on wetin happen as he say na just opposition dey wan create problem for where e mor dey.

He say nor be only govinor office spend di monie as pipo dey karey tok but na di whole ministry for di state, departments and agencies nai use am.

Anosike tok say “With wetin come outside for Q3 budget report of Abia State Govimet and to follow for how di govinor want make everytin dey open for everyone, e dey important make we explain di report.

“Di tin come even worse as some news for social media dey fly say na N1 billion nai Abia State Govimet spend for feeding and welfare for govinor office for this period.

“Di truth be say notin for that region don even use that kind monie for govinor office.”

Anosike come say di total monie wey dem don use take buy food for di whole ministries and bodies wey join di govimet na N223,389,889.84.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM