+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Sojas Don Karey Olota Community Chairman Join With Others

More than 10 pipo nai army don karey from anoda community wey be Olota say dem hand dey for di death of sojas wey die for Okuama on March 14.

One pesin wey dey stay di community nai say na yesterday morning nai 200 sojas enter inside Olota community wey nor too far from Okuama, carry di chairman, Matthew Olokpa, Bigi Edjekpewhu, German Obiokute, Kenneth Okorodudu Atua, with plenty others.

Di sojas enta with teree gunboats, but di hass ot German, and karey all di speed boat wey dey di jetty.

As dem land di community, nor be small beating nai dem put for Matthew Olopka bodi and as dem dey beat naso gun dey sound for up, bifor dem come karey di chairman and others go.

Prosper Evuarherhe, wey be di president general of di community tori pipo never fit tok to am but naw di village of Olota dey cry to govimet for epp.

Dis attack dey hapun just a day afta Senior Advocates of Nigeria and retired judges say make army stop that commitee wey di Defence Headkwata set to find out who kill di 17 sojas.

Dem say di pesin wey get right to set that kind committee na either federal govimet or di State govimet.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM