+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Succés Masra, Chad PM Wan Contest For President Seat

Prime Minister of Chad wey di military govimet put for di kontri affair Succés Masra, on Sunday say hin wan come out as president of di kontri.

Him dey tok e mind afta 6 days wey General Mahamat Idriss Deby Itno say hin too wan be president.

Masra na foma opposition leader wey run from di kontri for di time of Marshal Idris Deby Itno di president wey rule Chad for more that thirty years before kpeme for 2021.

Wey Masra come back to Chad, he go sign make peace with Deby Itno wey don already take over from where em papa stop before dem come out am as PM.

For 2016 nai Masra stop to work for African Development Bank.

As pesin wey start di Transformers party, wey dem dey do rally on Sunday nai di PM announce say he wan run for president position too.

Wey di kontri put Deby Itno make hin be di leader for short time, he tell Africa Union say make dem nor worry afta a year plus he go give power to civilian but as per say power dey sweet, Itno change mind to contest as president.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM