+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tanker Drivers Go Stop Work Today – NARTO

Anoda strike on Monday morning nai dey blow for air as Nigerian Association of Road Transport Owners (NARTO) tell dem members make dem karey all dum truck wey dey load petrol komot for road from today di 19 of February 2024.

Oil marketers bin say dem wan compare di moni wey dem take dey buy petrol.

While for di NARTO side, dem say even with di change wey enta for di downstream sector, oil marketers nor wan still change di price of how dem take dey gt tins.

Di one mean say govimet don komot hand for how to take dey control petrol price and na only private sectors nai go dey do am.

Na that one oyibo call Deregulation, but as di tin nor dey favour di Road transport owners nai make dem wan strike.

For letter wey dem write go give NUPENG for Feb 15, nai NARTO say di work don dey press dem cus of di way di economy be.

Dem say dem don try tire to see say changes dey for dem rates but e never get any gud result.

Di situation of di kontri nai make di association dey tell all dem members to komot bodi cus dem nor fit kwatinue like dis inside dis kind economy.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM