+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tiff Wan Finish Us For Awa Hostels – Ogwashi-uku Poly

Many students wey dey stay off campus for Ogwashi-uku Polytechnic don run from dem hostel cus of di way robbas take dey disturb dem day and nite.

Di way di robbas take dey come tiff pipo laptop, phones, even dey tell dem to do transfer from dem hakant.

Di students wey nor fit bear am again don run leave di different hostels for di community.

Some pipo say e never tay wey di tiffing start from one community wey dey close, before dem go close eye open e don spread enta some part for Ogwashi-Uku town.

Cus of di too much tiff attack, pipo come dey say dem don close di skool but Police Public Relations for Delta State, Bright Edafe, say na lie na break nai students go as dem never close di skool.

But to epp cool di attack wey dey for Ogwashi-uku, police don send many of dem men go there and even di Rector for do poly, Emmanuel Achuenu say di hostels wey dis robbas dey go nor even near di skool.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM