South Africa don turn adoda tin for pipo wey nor come from dem kontri and dis kind pipo wey dem dey afta na dose wey even be Afrika.
Difren video dey online as South Africa task force dey waka door to door dey tell Nigeria, Ghana and any pesin wey he bodi black say make dem go do dem own kontri to beta and leave South Africa for dem alone.
One new video now na man wet turn hesef to nite watcher as he dey waka for area wey pipo don already sleep for nite dey do video say pipo wey nor come from Southy dey sleep kulele while dem South Africa nor get where to sleep.
Di man as he dey waka dey video di area say “dis pipo wey nor come from awa kontri dey sleep for fine haux but we wey be South Africa wey dey outside cold. Dis pipo must go back to dem kontri, dem nor fit come here come remove sleep for awa eye.”
