+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Una go Tok Wey I Take Be Mercy Chinwo Pikin Papa, Nathaniel Bassey Sue Four Pipo   

Last week for social media no be small tok fly, afta gospel singer, Mercy Chinwo and her husband wey be Pastor Blessed show dem new baby son face to di world but bifor you ga say jack, online inlaws don dey ask kwestun why di baby resemble gospel singer Nathaniel Bassey.

Naso pipo start to do tok upadan say make dem go do DNA to confirm weda na Mercy Chinwo husband nai give her belle or na Nathaniel Bassey.

As mata don be, Nathaniel Bassey don write petition to Inspector General of Police, Kayode Egbetokun say make dem go arrest and punish di four pipo wey open mouth tok say Mercy pikin na hin son.

Na true hin lawyer nai di singer take write di petition, say na word wey go scatter hin marriage, and even as minister wey don dey song for years.

So make di four pesin Okoronkwo Ejike, Kingsley Ibeh, Terrence Ekot, and Dj Spoiltkid wey dey tok wetin dem nor know go face di law.

Na for inaide X nai Okoronkwo Ejike take start post afta Mercy Chinwo dem post pikin pinsure, he say make dem see Nathaniel pikin, naso others come comment dey ask when dem go do DNA test.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM